Zimbabwe President Robert Mugabe, don do 37 years as di leader of di southern African country. For inside all dis years, di man dey very popular because of some of im quotes and di kind words wey im dey use. Dis na five of im quotes wey im talk for different years inside different occasions. Five Mugabe quotes "I wan tell United States President, Mr Trump, abeg blow your trumpet. Blow your trumpet as di music go take promote values like unity, peace, cooperation, togetherness, dialogue, dat na who we be." UNGA, 2017 "Anoint person wey go take over, na inheritance? For democratic party, you no wan make dem dey appoint leaders like dat. Proper thing na for di people to appoint dem." - TV interview, 2016 "I don conclude - as President Obama don approve make people of di same sex marry, dey campaign for men wey prefer to befriend men, and im dey enjoy as di mata make am popular - if e necessary, me sef go waka go Washington DC, kneel down, then propose to am....
News and information blog